Big Brother Naija Season 5 housemates all dey up for eviction, meaning say time don dey reach for fans of Nigeria biggest television reality series to decide who dem want make e stay and who dem want make e leave di house dis week.
18 housemates for di BBNaija house dey up for eviction dis week and if you dey wonder how you go take vote your choice, dis na how.
Di only two housemates wey no go chop eviction alias get immunity na di Head of House Lucy Essien and her deputy Prince.
See how to vote your favourite BBNaija housemates
Three possible ways dey for you to cast your vote and you dey free to choose di way wey easy pass for you.
Mobile Site
Di number three way to vote na to visit Africa Magic mobile site.
Just cari ya fone, google Africa Magic, once you enta dia website you go find wia to vote.
Pesin wey choose to vote through website fit vote reach 100 times.
Voting through mobile site na FOC 9Free of Charge) but you go gatz pay for ya data.
DStv App
Anoda way you fit take vote for your favourite housemate na through di myDStv or myGOtv (dat na di ap of di organizers of di show, DSTV).
Here sha, di number of vote wey you fit to cast na based on which subscription package you dey do.
If na App you wan use, voting na free, but you go pay for data.
SMS
You fit vote through text message or SMS.
To vote through SMS, just type VOTE plus di name of di housemate as text message den send am to 32052.
If you dey vote through SMS, you fit vote reach 100 times and dem go charge 30 Naira for each time you sen di text.
How dis week eviction go be?
Inside dis season 5, Biggie introduce some kain new tins unto how Sunday evictions go be.
For dis Lockdown season, all housemates go dey up for eviction each week, except di Head of House and Deputy Head of House.
Housemates go do live eviction every Sunday. For di very first show, na di housemates go choose who among dem go go home.
Here, na turn by turn each housemate go take enta Diary Room to nominate one out of di four housemates wey get di lowest vote.
Housemate wey dem nominate pass n aim dem go evict.



No comments:
Post a Comment